“I still dey look as di horn dey tok wiked-wiked words. I dey look until dem kill di beast kon distroy en body, den trow am inside di fire wey dey kom out from di throne.
As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.
I dey look as e vex kon attack di ram, den e break di ram two horns and di ram nor get pawa to fight am back. Di goat trow di ram for groun kon dey mash am and nobody fit save am.