So Haman tell di king, “E get one tribe wey dem full evriwhere for dis yor kingdom wey get difren law. Dem nor dey follow di king law. So e nor dey good for di king to allow dem live.
Filistia pipol kommander si dem kon ask, “Wetin dis Hibru dey do for here?” Akish kon ansa, “Dis na David, King Saul savant and e don dey with mi for sometaim naw. E neva do anytin wey go make mi blame am since e don dey with mi.”