Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 6:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Den di king choose three pesin wey go dey shek wetin di govnors dey do and Daniel dey among di three wey dey make di govnors do wetin di king wont.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 6:2
14 Iomraidhean Croise  

Naw, make una go do wetin I tok, so dat my kingdom go get peace.”


Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.


Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.


E go give yu long life, plenty propaty and honor.


Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”


Just as di king tok, dem kon wear royal purpol klot give Daniel; put gold shain for en neck kon make am di nomba three man for Babilon.


Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”


Darius choose one hundred and twenty govnors wey go kare for di whole kingdom.


“God Kingdom bi like wen one king wey won know how en savants dey manage en business.


So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’


God wont make wi dey faithful to am.


“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan