Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 6:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 all of dem gada go meet di king kon tell am, “Awa king! Shebi yu sign orda sey for thirty days make anybody nor pray give human being or gods escept yu and yu sey who pray give any oda god, make dem trow am for lion pit?” Di king ansa, “Una dey korrect! E dey for Mede and Persia Law and dem nor go fit shange am.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 6:12
7 Iomraidhean Croise  

“So if my king go like am, make yu kommand sey make Vashti nor ever kom near di king again. Make yu let us rite am put for Persia and Media law, so dat dem nor go ever fit shange am. Den yu go give en place as kween to anoda betta woman.


Daniel enemies tell di king, “Awa king! Yu know sey Mede and Persian Law sey, any orda wey di king give, nobody go fit shange am.”


Abeg, awa king, make yu give and sign dis orda, so dat nobody go fit shange am and e go bi like Mede and Persia Law wey nor dey shange.”


But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.


Bikos of dis strong orda, di warda put dem for inside-inside di prison kon hook dia leg with big-big shains.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan