So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.
and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.
But dis na wetin Oga God wey dey lead heaven sojas tell mi, “True-true, as long as dem dey alive, I nor go forgive dem dia sin.” Mi wey bi God wey get pawa, don tok.
I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.