Den di pipol remember as e bi before; dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask, “Where di God wey save en pipol from di sea? Where di God wey give Moses en Spirit?
“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.
But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
“Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”
“Belteshazzar, na yu bi di majishan dem oga; I know sey di gods spirit dey inside yu and e nor get any dream or vishon wey yu nor know en meaning. I go tell yu my dream and yu go tell mi wetin e mean!