Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’
Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house!
So naw, if una don ready, wons una hear di trumpet, di horn, lyre, jita, harp and all di oda instrument sound, make una bow woship di image. If una nor gri, na wons I go trow una enter di fire. Abi una tink sey any god dey wey go save una?”
Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace.
All of us wey dey rule yor kingdom, doz wey dey wosh wetin wi dey do; di kounselor, wise men and all di oda royal men, don gri sey make yu give orda kon back am with pawa sey, ‘For thirty days, anybody wey pray to any god or human being wey nor bi yu, make dem trow am for lions pit.’