Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.
Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”
Levi pipol: Jeshua, Kadmiel, Bani, Hashabneaya, Sherebaya, Hodaya, Shebanaya and Petahaya kon tell di pipol sey, “Make una stand praiz di Oga una God bikos E dey forever and ever!” Den dem pray sey, “Wi go praiz yor holy name! Make yor name high pass evry blessing and praiz!