Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 2:2
16 Iomraidhean Croise  

For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean.


So di king kon ask di wise men wey know about matter wey koncern dia law and rule, bikos e dey always ask dem for advise.


Fero sef tell en native doctors and juju-men for Egypt sey make dem do di same tin.


I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.


But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”


Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.


yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.


Di wise men tell di king, “Nobody for dis world fit tell di king wetin e dream and know king don ever do dis kind tin to majishan, wise men or pipol wey dey si vishon.


Daniel ansa, “Di dream wey di king dream so, na dat kind dream wey wise men, pesin wey dey si vishon and majishan, nor go fit tok.


For dat time, some Babilon pipol kon go ripot di Jew dem give di king.


“Di sign dem wey E show us dey great well-well! Even en wonders dey mighty! God kingdom go dey forever and en pawa go last from awa generashon go rish di next one.”


So I orda make dem koll all di wise men for Babilon, so dat dem go tell mi wetin di dream mean.


Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”


So Filistia pipol koll di priest and doz wey dey si vishon kon sey, “Wetin wi go do with di Kovenant Box? Make una tell us how wi go take karry am go back to where e suppose dey.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan