18 E kon ask dem to pray to God wey dey heaven make E for sorry for dem kon show dem di dream and en meaning, so dat en and en friends nor go die with di oda-wise men for Babilon.
wot of if na five nor make am rish fifty? Yu go distroy di town, bikos five nor make am rish fifty?” Oga God ansa, “I nor go distroy di town if I si forty-five pipol for der wey dey fear mi.”
Assyria king don send en offisa oga kon curse God. Make God wey bi yor God hear dis curse, so dat E go ponish di pipol wey curse am. So make una pray to God for all awa pipol wey remain.”
Wen dem sey make dem leave di tree body for groun, e mean sey dem go give yu back yor kingdom wen yu don know sey na God bi Oga of all ogas for dis world.
Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.
David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!” Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”