1 For di sekond year wen Nebukadnezzar dey rule, e kon dream many dreams. Di dreams dey disturb en mind and e nor fit sleep,
Thru-out dat nite, di king know fit sleep, so e sey make dem bring di ofisas rekord book for di kingdom kom, den dem kon bring and read am for am.
For di fourt year wey Jehoiakim, Josaya pikin bi king for Judah, God tok to Jeremaya about all di pipol for Judah. (Dis na di first year wey Nebukadnezzar dey rule for Babilon.)
But di king sey, “I nor fit remember wetin I dream and I nor know wetin di dream mean.”
I dey happy to tell una di many signs and wonders wey God Almighty don do for mi.
But I dream one bad dream wey make mi fear. Wetin I dey tink as I sleep for my bed and di vishon for my mind really make mi fear well-well.
Dat time, King Belshazzar kon dey fear well-well and shake anyhow, but en royal men nor even know wetin dem go do.
Den di king go back to en palis. But for nite, di king nor fit chop, sleep or sey make dem play music for am.
Di first year wen Belshazzar bi king for Babilon, Daniel dream one kind dream kon si plenty vishon wen e dey sleep, so e rite di dreams for book.
“Di vishon wey I si dey disturb mi.