Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”