Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Daniel 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But en kingdom go skata at wons go di four korna for di world and four oda kingdoms go raiz and nor bi en shidren or family pipol go rule dis pipol and di kingdoms nor go get pawa like en own.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Daniel 11:4
24 Iomraidhean Croise  

Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!


Afta I don take dem komot dia land, I go sorry for dem kon bring each nashon kom back to en own land again.


But I go rut and distroy any of doz nashons wey nor gri obey mi.” Mi, wey bi God, don tok.


If I sey I go rut, break or distroy any nashon or kingdom


All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”


But God tell mi Jeremaya, “Make yu go tell Baruk sey, ‘I go soon skata wetin I build kon rut wetin I plant. I go do like dis for evriwhere for di world.


I go make breeze blow against Elam from difren direcshon kon skata en pipol go evriwhere, until en pipol don run go hide for all di kountry wey dey dis world.


God kon tell mi, “Man pikin, tok to di breeze. Tell di breeze sey God wey get pawa dey kommand am to kom from difren place kon give life to dis body dem wey dey groun, so dat dem go get life.”


Daniel sey: “As I dey dream dat nite, I kon si breeze dey blow from di four korna for di eart and di sea dey make strong nois.


“Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.


“As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.


Di horn wey break wey four oda horns kon grow kom out for en place, na di four oda kingdoms wey go kom from en nashon, but dem nor go get pawa like am.


Di goat kon dey strong more-more, but leta, en horns kon break. Den four horns kon grow kom out from where di two horns for break and each of di horns face difren direcshon.


God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere.


E ansa, “Dis na di four spirit for heaven wey dey stand for God wey kreate di world front.” Dem dey go do en work.


Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


Den, I si for angels stand for di for korna for di eart and dem whole di for breeze, so dat e nor go blow for di eart, di sea or for any tree.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan