27 Di two kings go sidan chop for di same tabol, even doh dem get bad belle for each oda; dem go dey deceive each oda. Dem nor go get wetin dem won get, bikos di time neva rish.
Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
Naw, mi God wey get pawa dey ask: Dis vine go prosper? No! I go plok all en fruit kon rut am komot groun and en leaf go dry kon die. I nor nid strong hand or many pipol, bikos e nor go hard mi to rut am from groun.
For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
Den Siria king for nort go-go house with all di tins wey e karry for war. En mind go dey against di holy kovenant. E go kause wahala, den e go-go e own land.
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”
Make yu rite am even doh e neva rish time for di vishon to happen. But di time go soon rish and wetin I show yu, go happen. E fit bi like sey e nor go happen, but make yu wait; e go must happen and e nor go tey again.