10 Siria king sons go dey ready to fight and dem go gada many sojas. One of dem go flow like wota kon attack dia enemies strong town.
God go distroy di high wall wey Moab pipol take dey protet diasef and E go bring dem down forever.
Di sea rush enter Babilon and naw e don kover di town.
Anybody wey ask am kweshon about di High Priest, e go kill-am.
Di pipol wey dey chop with di king, go plan to kill-am! Dem go kill and skata many of en sojas.
“E nor go tey before one of di woman broda, go bi king. E go attack Siria king, dia sojas, enter di place wey strong pass kon kill dem.
Siria king go attack Egypt, but e nor go susid.
“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.