I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”
Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.