10 Den one hand tosh and karry mi stand up well; but I still dey shake.
So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
Den di angel tosh mi again and my body kon strong.
As e dey tok to mi, I kon faint for groun. But e tosh mi and I get up.
Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.
Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,