Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
Hegai like Estha bikos of wetin e dey do and how e dey do tins. E know waste time before e sey make dem dey trit Estha well both for wetin e wont and food wey e go chop. E give Estha di best place to stay kon choose seven girls from di royal palis wey go dey attend to am.
So e tell Daniel, “I dey fear my masta di king. Na-im tok di kind food wey una go chop and wine wey una go drink; wot of if e sey yu dey tin and di oda yong men dey fat! Wetin I go tell am?
kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.