For dis time, Filistia pipol don still go fight Judah towns for di low lands and Negev Valley. Dem take-ova Bet-Shemesh, Aijalon, Gederot and Soko, Timnah, Gimzo and all di towns wey near dem kon stay der.
God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.
God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.
Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.
Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.
Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.