Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Amos 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Amos 1:11
28 Iomraidhean Croise  

Naw, Ammon, Moab and pipol for Mount Seir dey kom! Wen Israel pipol komot from Egypt, Yu nor gri make dem fight dis pipol. Dem just pass and dem nor tosh dem.


But naw, make Yu si how dem dey pay us back. Dem dey kom drive us komot from awa land wey Yu give us!


Edom pipol don fight, win and karry Judah pipol go as slave again.


My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”


Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?


Always dey kontrol yor tempa, bikos vexnashon go turn yu to fool.


I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.


But e don late well-well, bikos dem don rijet wetin dey good, so dia enemies go porshu dem well-well.


But Egypt land go bi desert and na only dirty go dey Edom land, bikos dem attack Judah kon kill innocent pipol.


E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.


but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.


God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?” God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob


Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”


So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well.


Make una nor hate Edom or Egypt pipol, bikos Edom pipol na una brodas and una stay as strenjas for Egypt.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan