so E kon sey, “If dem dey do dis as pipol wey dey speak one language, den nor-tin go stop dem for anytin wey dem won do. E nor go tey before, dem go fit do anytin wey dem wont!
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean.
Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell.
Den I si anoda angel dey fly for sky and e karry di Good News wey go dey forever dey kom prish give di pipol for dis eart, kountries, tribes, language and groups.