Di way wey dem take kill-am kon make wetin God tok happen wen E tell Jehu sey, “Na four generashon for yor shidren go rule Israel.” And dat na wetin happen.
As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.
As Jesus still dey tok, Judas, one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”
Afta dem don argue well-well about di matter, Pita kon stand up sey, “My brodas, una know sey before-before, na mi God choose make e go prish give Gentile pipol make dem hear and bilive en word.
na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.
Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”
Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.
Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am