Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 8:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 8:3
15 Iomraidhean Croise  

Dat day, God kon make kovenant with Abram sey: “From Egypt borda go rish Eufrates River, I promise to give all dis land to yor shidren,


Siria pipol si as Israel pipol win dem, so dem kon go gada demsef again.


Hadadeza kon send for more Siria sojas wey dey di east side for Eufrates River and dem sey make Shobak wey dey kommand Hadadeza sojas for Zobah bi dia kommander.


Wen di kings wey dey follow Hadadeza si sey Israel sojas don win dem well-well, dem kon go make peace with David and dey obey am. So, Siria pipol nor gri help Ammon pipol again.


Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.


Igal, Natan pikin wey kom from Zobah; Bani from Gad;


Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.


Afta, David attack King Hadadeza for one Siria land for Zobah near Hamat aria. King Hadadeza bi won take-ova di aria for Eufrates river side.


E go Hamat-Zoba kon seize am.


My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.


Make di king rule from sea go rish sea and from Eufrates River go rish di end for di eart.


Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.


Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea.


Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan