Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 7:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 7:8
17 Iomraidhean Croise  

So Natan tell David, “Na yu bi di man and dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok. I make yu king for Israel and I save yu from Saul.


Di woman tell am, “Why yu do dat kind tin to God pipol? Yu neva let yor own pikin kom back from where e hide put since, so yu don kondemn yorsef with wetin yu just tok so.


David wey bi Jesse pikin, na God make am great well-well. Na dis pesin, Jakob God choose as king and na-im rite betta songs for Israel pipol. Dis na di last words wey David tok:


David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”


Before-before wen Saul still bi awa king, yu lead Israel pipol for war and God promise yu sey yu go rule en pipol and bi dia king.”


David ansa, “I dey dance to honor God wey choose mi, instead of yor papa and en family. E make mi lead Israel wey bi en pipol. I go kontinue to dey respet God with my dance


Solomon ansa, “Yu show great love to David my papa wey bi yor savant and e dey good, dey respet and always dey honor Yu. Yu still show am yor great love wey nor dey end, wen Yu make one of en pikin king afta am.


‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ”


So, make yu tell David my savant sey, mi wey bi di Oga God sey, ‘I take yu from where yu dey guide sheep kon make yu lead my pipol, Israel.


So David pray, “My Oga God, na mi do wrong; na mi sey make dem kount pipol. Wetin all dis poor pipol do? Abeg, make Yu leave dis pipol kon ponish mi and my family.”


But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.


God favor David well-well and e sey e go build house for God


Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


“For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan