Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’
Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
If una do am, den di kings and di prince go enter Jerusalem gates kon get di same royal pawa wey David get. Dem with Judah and Jerusalem pipol go ride dia horse and Jerusalem town go always dey full with pipol.
Dem go stay for di land wey I give Jakob wey bi my savant; di land where dia grand-grand papa dey before. Dem with dia shidren and grand-shidren go stay der forever. Na from my savant David house, dia king go always kom from.
For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”
Abeg, make yu forgive di sin wey wi kommit and true-true God go make yor house great, bikos yu dey fight God fight. All di days wey yu go stay for dis eart, yu nor go put hand for bad tin.