Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 7:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Bad pipol dey opress dem since dem kom dis land, but e nor go happen again. I promise sey, I go make yu win all yor enemies and I go give yu many shidren.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 7:11
20 Iomraidhean Croise  

Den King David kon go stay en house. And God keep am save from en enemies.


But Yu dey even do di ones wey pass dem. Yu don promise my shidren-shidren tins for many years wey dey kom and Yu, Oga God don let mi si dis tins.


Oga God Almighty wey bi Israel pipol God! I dey pray dis prayer with all my heart, bikos Yu don show mi yor savant, all dis tins kon promise mi sey, ‘Yu go make my shidren-shidren king forever.’


If yu obey and follow my laws and yu win my heart as yu dey obey my kommand, just as David my savant do, I go always dey with yu. I go make yu king for Israel and I go make sure sey yor shidren-shidren go rule afta yu, just as I do for David.


God don already plant mi put for David, my papa throne; E don keep en promise and E don give mi and my shidren-shidren di kingdom. I use God name take swear sey, today-today, Adonijah must die!”


wen I choose pipol to dey judge dem. I go distroy all yor enemies.’ I pray sey, ‘Mi di Oga yor God go give yu many shidren wey go bi kings.


E go build temple for mi. I go bi en papa and e go bi my pikin. En kingdom for Israel, go dey forever and ever.’ ”


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


Dia enemies opress dem kon make Israel pipol dey do wetin dem tok.


Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.


E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.


Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.


na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;


Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.


Abeg, make yu forgive di sin wey wi kommit and true-true God go make yor house great, bikos yu dey fight God fight. All di days wey yu go stay for dis eart, yu nor go put hand for bad tin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan