Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 6:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Afta, wen David go greet en family for house, Mikal kom meet and tell David for outside sey, “Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef for en girls savant and ofisas front!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 6:20
23 Iomraidhean Croise  

I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”


David wey wear only linen for en waist, dance well-well to take honor God.


As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.


Wen e don give di sakrifice finish, e bless di pipol with God name


kon give dem food. David kon give bread, rice and meat wey dem roast to evribody for Israel, den all of dem kon go dia house.


Den evribody go back to en house and David go en house too go bless en family.


Dem nor get sense or name and dem porshu dem komot di town.


Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.


My God, I go praiz Yu, bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.


Make yu nor dey too wiked or bihave like fool, if not, yu fit die before yor time!


For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der.


Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”


Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?”


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.


Saul pikin dem name na Jonatan, Ishvi and Malki-Shua. E get two girls; di senior one na Merab, while di yonga one na Mikal.


Mikal wey bi Saul pikin, like David. Wen dem tell Saul wetin dey happen, en belle kon sweet am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan