den di king tell Ittai wey bi dia leader sey, “Why yu won follow us go?” Go back make yu go stay with di new king. Yu bi strenja wey dem porshu komot en kountry.
E divide dem into three groups kon send dem out. Na Joab, Abishai wey bi Joab broda and Ittai wey kom from Gat, dey kommand each group. Di king tell en men, “I go follow una go.”
Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.
Di pipol wey dem choose to assist dem na: Zekaraya, Jaaziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Benaya Maaseaya, Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya and Obed-Edom and Jeiel wey dey guide di gate.
Doz wey dem choose to blow trumpet for di Kovenant Box front na: Shebanaya, Joshafat, Netanel, Amasai, Zekaraya, Benaya and Elieza and all of dem na priests. Dem still choose Obed-Edom and Jehaya make dem dey guide di box too.
Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.