9 Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.
David ask en men dat day, “E get anybody for here wey hate Jebus pipol rish mi? Make wi kill dem? Den, make una pass di wota go kill doz poor and blind cripple.” Na dis make dem sey, “Doz wey dey blind and cripple, nor fit enter God house.”
Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.
Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
King Hezekaya use all en pawa take build di wall wey dem break. E build towa and wall for outside kon fence David Town round. E make many weapons and shields.
Shallum pikin, Kol-Hozeh, wey bi ruler for Mizpa aria, ripair di Well Gate. E ribuild and roof am, kon fix di doors, en bolts and bars. For Siloam Pool, near di royal gardin, e still ripair di wall go rish di road wey lead to David Town.
But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”