Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 5:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 David kon dey strong evriday, bikos Oga God wey dey mighty, dey with am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 5:10
19 Iomraidhean Croise  

For dat time, King Abimelek and Fikol wey bi kommander for en soja kon tell Abraham sey, “God dey with yu for evritin wey yu dey do.


Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.


I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.


E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.


Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.


But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.


Who bi dis King wey get glory? Na di Oga God of all ogas; Na-im bi di King wey get glory.


God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.


God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.


Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


But naw, Oga God sey: Zerubabel make yor heart strong, Joshua, Jehozadak pikin wey bi High Priest, make yu don fear too. All di pipol wey dey di land, make una mind strong. Make una bigin work, bikos I dey with una.


Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David.


David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.


Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan