Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 4:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Not to tok about una wey do evil kon go kill pesin wey dey sleep for en own house! I go take revensh and as una kill-am, na so una go take die too!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 4:11
19 Iomraidhean Croise  

So naw, I go drive yu komot from di groun where yu for kill yor broda; di groun wey swallow yor broda blood from yor hand.


So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.


So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.


Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”


Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.


Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”


God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.


Yes! Make God always dey remember en sins and make nobody remember en name again.


Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.


“Anybody wey nak and kill anoda pesin, dat pesin must die too.


If to sey I take sickness attack yu and yor pipol, all of una for don die finish.


But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.


Wen good pesin listin to wetin bad pesin dey tok, e go bi like wota wey nor good or well wey get poizin.


So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’


My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.


Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.


Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan