2 Samuel 24:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 So David orda Joab wey bi di sojas oga, “Make yu go round Israel tribe with yor ofisas; from one end to anoda for di kountry kon kount di pipol. I won know how dem plenty rish.”
So very early for di next day, Abraham take some food and wota kon give Hagar. E put di food for Hagar shoulder, gi-am en pikin kon sey make dem dey go. So dem go kon dey waka anyhow for Beersheba wildaness.
“I dey advise yu sey make yu bring all Israel pipol togeda, even doh dem many like san for wotaside kon skata for evriwhere for di kountry. Make yu yorsef lead dem go di war.
Joab wey en mama name na Zeruaya and David ofisas kon meet demsef for di pool for Gibeon. All of dem sidan; one set dey for one side for di pool and di oda set dey for di oda side.
So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel.
David orda Joab and di oda ofisas sey, “Make una go round Israel from one end to di oda for di kountry kon kount all di pipol, bikos I won know how dem many rish.”
Wen Babilon ofisas send pipol go find out about di sign wey happen for di land, God kon leave di king alone, so dat E go fit test am, make E for know wetin dey en mind.
about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi.
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.