Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”
Na di twenteth year wey Atazazes bi king, e make mi govnor for Judah and since den kon rish naw wey bi di twelft year wey I dey rule Judah (di thirty-two years wey Atazazes don dey rule), mi and my family nor chop di food wey dem suppose dey give mi as govnor.
But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.
God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.