2 Samuel 20:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
6 So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”
Uriaya ansa, “Israel and Judah men with di Kovenant Box dey war; Joab wey bi my kommander and en ofisas, kamp for open place. How I go take go house go chop, drink and sleep with my wife? So, I use evritin wey dey holy take swear sey I nor go fit do dat kind tin.”
But di man ansa, “Even if yu give mi one hundred pieces of silva, I nor go use my hand kill di king pikin. All of us hear wen di king dey kommand yu, Abishai and Ittai sey, ‘Bikos of mi, make una nor tosh or kill Absalom.’
E divide dem into three groups kon send dem out. Na Joab, Abishai wey bi Joab broda and Ittai wey kom from Gat, dey kommand each group. Di king tell en men, “I go follow una go.”
Naw, make yu go make yor men heart strong. I use God name take swear sey if yu know go meet dem, nobody go stay here with yu dis nite. Na dat go bi di worse wahala wey yu go ever si for yor life.”
But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
Joab broda, Abishai wey dia mama na Zeruaya, na leader for di three. E use en spear take fight against three hundred men kon kill dem and en name dey famous among di three.
Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas.
Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.
David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?” Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”