Amasa body dey di road centre and en blood spread around am. Wen Joab men si sey evribody dey stop wen dem si di body, dem drag di body enter di bush korna kon kover am with klot.
Nor bi awa plan bi dat. One man wey dem dey koll Sheba wey bi Bikri pikin, wey kom from Efraim hill kountry, naim start di fight with King David. If una bring dis man kom out, I go leave una town.” Di woman kon sey, “Wi go trow en head pass di wall kon give una naw-naw.”