David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?
e kon go kollect Saul and Jonatan en pikin bones from Jabesh pipol for Gilead. (Dem bin karry dem form Bet-Shan for where dem hang dem put afta Filistia pipol kill Saul for Mount Gilboa.)
Dem tell Filistia pipol sey dem don make David king for Israel, so dia sojas kon ready to go fight am. Wen David hear am, e kon go di aria wey dey save.
So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.