Abner tell David, “My king, I go-go win Israel pipol kom give yu. Dem go take yu as king, den yu go get wetin yu dey find and yu go rule di whole land.” David kon make Abner know sey e dey save and e tell am make e dey go.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.