Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 16:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Abishai wey en mama name bi Zeruaya kon tell di king, “My king, why yu dey let dis dog curse yu? Make I go der go kut en head komot!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 16:9
13 Iomraidhean Croise  

Abishai wey bi Zeruaya pikin kon sey, “Make dem kill Shimei, bikos e curse di pesin wey God choose to bi king.”


But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”


Na so Joab and Abishai wey bi en broda take kill Abner, bikos e kill Asahel dia broda for war for Gibeon.


Di tin make Abner vex well-well and e kon sey, “Yu tink sey I go betray Saul? Yu tink sey na Judah I dey serve? I always dey respet Saul wey bi yor papa, en broda and en friend and I make sure sey David nor win una. But today, yu sey I dey sleep with yor papa girl-friend!


Mefiboshet bow again kon sey, “Oga, I nor betta pass dog wey don die, why yu dey good to mi like dis?”


“Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.


Wen James and John si wetin happen, dem kon sey, “Oga God, yu wont make wi koll fire down from heaven kon kill dis pipol?”


Paul ansa, “I nor know before sey naim bi di High Priest, bikos God word sey, ‘Make yu nor tok bad about di pesin wey dey rule yor pipol.’ ”


Make una respet evribody. Love dis awa family wey bilive Christ. Make una fear God and respet di king.


“Na who Israel king dey look for? Na who e dey porshu? Dog wey don die or ordinary ant?


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan