Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.
Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,