Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 15:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Na two hundred men from Jerusalem, Absalom karry follow body. Bikos dem nor know wetin Absalom won do, dem kon follow am with klean mind.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 15:11
8 Iomraidhean Croise  

But Abraham tell mi sey na en sista and even di woman still sey Abraham na en broda. All wetin I do na with betta mind and I neva do any bad tin.”


Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.


Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


Na today bi di first day wey I dey tok to God for am? E nor fit happen! Make di king nor blame en savant or evry priest for my papa house. Bikos yor savant nor know anytin wey dey happen at-all.”


And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan