8 Wen di girl go der, e si Amnon sleep for en bed, so e take flower kon bake kake for en front.
So David send message go meet Tamar for di palis sey, “Make yu go Amnon house go make food for am.”
E remove di kake from di pan kon go give Amnon make e chop, but e nor gri chop, instead e sey, “Make evribody go outside,” den all of dem kon komot.
Anybody wey sleep with en sista, weda na en papa or mama pikin, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
Di woman kwik-kwik kill di small melu wey e get, take some flower, prepare am kon bake bread wey nor get yist.