2 Samuel 11:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.
Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
So Potifa leave evritin wey e get for Josef make e kare for dem. So di only tin wey koncern Potifa for di house, na to chop. Josef fine well-well and e get betta karata.
Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”
bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.