Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




2 Samuel 11:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Before dry sizin, for di time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipol sojas and dem defeat Ammon pipol kon take-ova Rabbah town. But David stay for Jerusalem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




2 Samuel 11:1
15 Iomraidhean Croise  

So as Ammon sojas si sey Siria sojas dey run, dem too kon bigin run from Abishai enter di town. Den Joab kon go back to Jerusalem.


Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”


For di next rainin sizin, e gada en men kon follow dem mash go Afek town go attack Israel pipol.


Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town.


Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.


So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol?


Time dey to love pesin and time dey to hate pesin too; time dey to fight war and time dey to make peace.


But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois, den dem go distroy and burn dia village rish groun. Den Israel pipol go take dia land back from doz wey take am from dem.


Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.


One road go show di king where e go pass rish Ammon town for Rabbah and di oda one go show am Judah road; di strong town wey dey Jerusalem.


So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.


Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.


For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)


Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan