Shame nor let di men go back to dia house. Wen David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko till dia hair go grow again.
Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.
Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.
eight men kom from Shekem, Shiloh and Samaria. Dem don skrape dia hair, tear dia klot kon kut demsef to show sey dem dey mourn and dem karry korn and incense go offa for di temple.