2 For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.
Wen David rish on-top di hill where e go for fit woship God, en friend, Hushai wey kom from Ark land, wey David trust well-well, kom meet am. E wear tear-tear klot kon pak dirty full en head.
even di messenja wey kom meet and tell mi for Ziklag sey Saul don die tink sey e dey bring good news kom give mi. I whole and I kill-am. Dat na di reward wey I gi-am for en good news!
“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
For di third day, Estha wear en royal dress kon go stand for di inna kourtyard gate for di palis wey face di throne room and di king sidan for di throne.
Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.
From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
Wen di savant don go, David stand kom out from where e hide put near di stone, e knee down kon bow three times. Den dem kiss each oda kon bigin kry, but na David kry pass.