Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 9:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So Saul ansa, “Okay! Make wi go der. But wetin wi go give di man since wi don finish all di food for awa bag? Wi nor get any gift wey wi go give God savant.” Den e ask en savant, “Na wetin wi still get?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 9:7
10 Iomraidhean Croise  

Den di king tell di profet, “Make yu kom chop for my house and I go give yu sometin.”


Yu go gi-am ten bread; some kakes and honey. Den ask am wetin go happen to awa pikin and e go tell yu.”


Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”


Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”


Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot.


So di king tell Hazael, “Make yu take gift go give di profet. Tell am make e help yu ask God, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”


Den Hazael kon go visit Elisha. E karry gift and forty kamel wey full with all di fine-fine tins wey dey Jerusalem follow body. Wen e rish der, e stand for di profet front kon sey, “Na yor pikin, King Ben-Hadad for Siria send mi kom ask yu sey, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”


Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”


Abeg, make yu nor komot until I bring food kon offa give yu.” Di angel ansa, “I go stay here until yu kom.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan