Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”
For dat time, Israel pipol nor get king. But e get one man from Levi tribe wey dey stay for Efraim hill kountry. One day, e bring one girl kom from Betlehem for Judah as en girl-friend.
E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.