Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 9:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 One day, Saul papa donkey kon waka lost, so Kish kon tell Saul, “Make yu take one savant follow body, den make una go find di donkey.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 9:3
7 Iomraidhean Croise  

E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village.


Una wey dey ride fine donkey; wey dey use fine blanket for una horse and doz wey dey take leg waka, make una tok about am.


Saul papa broda kon ask en and en savant, “Na where una go?” Saul ansa, “Wi go look for di donkey. But wen wi nor si dem, wi kon go meet Samuel.”


Wen yu leave mi today, yu go si two men near Rashel Grave for Benjamin borda wey dey Zelzah. Dem go tell yu, ‘Di donkey dem wey yu dey fine, dem don si dem. Yor papa nor dey worry for di donkey again, but e dey worry for una too. E dey ask sey, “Wetin I go do naw wey I nor si my pikin?” ’


E get one pikin, en name na Saul and e fine well-well. E nor get anybody for Israel wey fine rish am and e tall pass evribody for Israel.


Make yu nor worry about di donkey dem wey lost three days ago, bikos dem don si dem. But na who Israel pipol dey look for? Na yu and evribody for yor papa house?”


So Saul cross Efraim hill kountries kon pass thru Shalisha land, but dem nor si di donkey.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan