God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.
Den e bring Benjamin tribe akordin to family and na Matri family dem choose. At last, dem kon choose Kish pikin wey en name na Saul wen dem trow di dice. But wen dem look for am, dem nor si am.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”