Assyria king don send en offisa oga kon curse God. Make God wey bi yor God hear dis curse, so dat E go ponish di pipol wey curse am. So make una pray to God for all awa pipol wey remain.”
I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.
If dem really bi profet or get my message, make dem pray give mi, di God wey dey mighty sey, “Make Yu nor allow dem karry all di betta-betta tins wey remain for di temple and palis, go Babilon.
kon tell mi: “Abeg, make yu do wetin wi won tell yu so! Make yu help us wey dey alive pray to di Oga awa God. Wi many before, but naw, yusef dey si sey wi nor many again.
So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.